Monday, 22 June 2015

Nigeria Pidgin Proverbs & Their Meanings

NIGERIA PIDGIN PROVERBS

*Craze no hard to form,na the trekking be wahala.
English translation: Easier said than done.


*No matter how hot your temper be,e no fit boil beans.
 English translation: Calm down, your temper won’t solve the problem

*Chicken wey run from Borno go Ibadan go still end up inside pot of soup.
English translation: You can’t run away from your destiny

*Today’s newspaper na tomorrow Suya wrap
English translation: Keep calm! Nothing lasts forever

*Cow wey dey in a hurry to go America go come back as corn beef
English translation: Just be patient. Let the game come to you. Don’t rush!

*Akara and moin moin get the same parent,na wetin dem pass through make dem different
English translation: How you start doesn’t matter, what matters is how you finish.

*Leave matter for Mathias and Sabi for Sabinus
English translation: Give everyone what they deserve.

*The difference between kpekere and plantain chips na packaging
English translation: Don’t judge based on appearance alone

*Escort me, Escort me, na im slave trade take start
English translation: Serious things sometimes start like a joke

*The water wey dem use take make eba can never be recovered.
English translation: Don’t cry over spilled milk.
 
*bring suya bring suya na cow dey suffer am

translation- the good tin u are enjoying is a result of someone's hard work

*nor be power dem take dey stand d1ck

translation- u don't always need physical strength to get things done

*lion say if na big belle dem dey look, he for nor be King for the same bush wen elephant dey

translation- the strength of a man is not been measured by his size

*okro say he know say na u buy am, but if u nor chop am with respect he go spoil or shirt

translation- don't treat a lesser fellow with disdain, he might be angry & disgrace u











No comments:

Post a Comment